21 Even if awa pikin win award, wi nor go know, bikos wen pesin don die, e nor dey know wetin dey happen again.
But en body go pain am and en soul go kry for am.”
Bikos wen pesin die, e nor kare about wetin happen to en family.
Wiked pipol fit dey great naw, but e nor go tey before dem go die go like grass and korn wey dem kut trowey.
Wi bi like shadow wey dey waka pass and evritin wey wi dey busy dey work for, nor mean anytin. Wi dey gada money keep and wi nor know who go spend am.
E know di value for evritin wey e dey make and e dey work go rish nite.
Pipol wey dey alive naw, know sey one day dem go die, but pipol wey don die, nor know anytin and dem nor get any reward again; pipol nor dey remember dem again.
Na Yu bi awa papa. Even if Jakob and Abraham wey bi awa grand-grand papa sey dem nor know us, Yu God na awa papa and na Yu dey always save us.
As e dey die, di wimen wey dey with am kon sey, “Nor fear! Yu don born boy!” But e nor ansa dem or listin to wetin dem dey tok.