16 “Naw, bikos na Yu dey kount my steps, Yu nor go kount my sins again.
Yu dey look to si weda I go sin, so dat Yu nor go forgive mi.
Den wetin make Yu dey look for my sins and evry mistake wey I make?
Yu don put big shain for my leg and evriwhere wey I waka go, Yu dey wosh mi.
God know evritin wey I dey do; E dey si evry step wey I dey take.
E tie my leg with shain; E dey si evriwhere wey I waka go.’
God dey si evritin wey wi dey do. E dey si evry step wey wi take.
Dem dey gada hide dey look mi; dey monitor mi as I dey waka and dem dey ready to kill mi.
God dey si evritin wey yu dey do and E know evriwhere wey yu dey go.
Yu dey make betta plan kon do mighty tins. Yu know evritin wey pipol dey do and Yu dey reward dem akordin to wetin dem do.