14 If pesin don die, e fit kom back to life? But I go wait for betta time wen dis trobol don pass mi.
But Barzillai ansa. “I nor go dey dis life tey again, why I go follow my king go Jerusalem?
Even if E kill mi, I go still dey bilive am; I go still tell am wetin dey do mi!
“I wish sey Yu go hide mi for where dead body dey; den wen Yu nor dey vex again, Yu go remember mi.
Den, Yu go koll and I go ansa and Yu go kon like mi wey Yu use yor hand take make.
Yu know as human being life bi from di biginnin. Even di nomba of dia days wey dem go live, Yu don setol am and Yu nor dey shange.
but God go blow all of dem trowey like dust. Pipol wey know dem before go sopraiz kon ask, ‘Where dem go?’
Job stay 140 year afta di trobol wey e face, e si en grand and great grand-shidren dem before e die.
“Evritin wey man dey do for dis life nor bi struggol? Abi awa days nor bi like savant wey dem hire to work?
So, make yu dey patient, as yu dey wait for God and get strong mind. Yes! Make yu dey patient, as yu dey wait for am.
Di two of dem dey waka go di same place and bikos God kreate dem with san, wen dem die, dem go turn to san again.
I go really wait for God wey don rijet Jakob family; I go wait for am.
Why una tink sey God nor fit raiz pipol wey don die?
E go use en pawa wey make am Oga God for evritin, take shange dis awa ordinary body and awa body go kon bi like en own wey get glory.
And doz wey don die inside sea kon kom out. Deat and grave release di ones wey dey inside dem and God judge dem akordin to wetin dem do.