9 If God look yu well-well, E go si any good tin for yor body? Yu feel sey yu fit fool God as yu dey fool human being?
Na God get strent and wisdom; di pesin wey dey lie and di one wey dem dey lie give, all of dem dey God hand.
But if pesin die, na di end bi dat. Dem don die; so where dem dey naw?
Na pipol wey dey laf mi dey round mi; e dey pain mi as I dey look how dem dey wiked mi.
But I wish sey dem test Job rish di end, bikos e dey ansa like wiked pesin.
Look mi well, den make Yu tell mi wetin I dey tink! Test mi and Yu go know wetin I wont!
E go know, bikos E know wetin dey evribody mind.
So make una nor laf as I dey warn una, if not, e go hard una well-well to eskape. Bikos I hear wen God wey get pawa sey E go distroy di whole kountry.
Na mi wey bi God dey si and test human being heart. I dey trit each pesin akordin to how e dey live en life and wetin e dey do.