8 Abi yu dey try to tok for am? Na yu won tok for God?
Even if yu dey pritend sey yu dey sorry for mi, God go still katch and ponish yu.
I nor go support one pesin for dis matter and I nor go praiz anybody sef!
E nor dey support rulers or rish pipol against poor pipol, bikos na-im kreate all of dem.
Wise pipol still tok dis tins too: E bad well-well if judge nor dey judge well for kourt.
“ ‘Make una dey honest and pure wen ever una dey judge any matter. And make una nor dey trit poor pipol matter anyhow kon dey show good face to pipol wey get money.
So, I go make di pipol hate una well-well, bikos una nor dey do wetin I tell una and wen una dey tish my pipol, una nor dey trit evribody ekwol.”