Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 13:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Yu bi oga for lie-lie; yu bi like doctor wey nor fit trit pesin wey dey sick.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 13:4
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I ansa am, “All wetin yu tok so, nor bi true. Na only yu arrange dis story.”


“I don hear many words like dis before. Yor konfort na more trobol for mi!


But I nor go tish yu, bikos yu don si am by yorsef. So wetin make yu dey tok all dis bad tins?”


But my friends, una don show sey una bi like wota wey dry bikos rain nor fall!


To misef, una bi like dat wota; una si fear kon bigin shake.


Wiked pipol lie full my ear, but I dey obey yor kommands with all my heart.


Make una listin to wetin mi wey bi God tok! I hate doz profets wey dey tok dia lie-lie dreams kon lead my pipol komot from di trut. I nor send dem and dem nor dey help my pipol at-all. Mi, wey bi God don tok.”


Nobody go kare for una or cure una sore; una nor get hope at-all.


Egypt pipol! Make una go Gilead go find medicine, but all una medicine nor go work and nor-tin go fit heal una.


Dem dey trit my pipol wound like sey na ordinary tin. Dem sey, ‘Evritin go dey okay!’ Wen dem know sey nor bi so e bi.


Medicine nor dey Gilead again? Doctors don finish for here? If dem dey, wetin make dem neva cure my pipol?


Una nor gri kare for di ones wey dey weak; heal di ones wey dey sick; bandage di sore wey some get; go find di ones wey waka anyhow or look for di ones wey lost. Instead, una dey trit dem with wikedness.


Wen Israel si as e dey sick and Judah si as e sore big rish, dem kon go meet Assyria great king make e kom help dem, but e nor fit cure or heal dia wound.


Wen Jesus hear dis, e tell dem, “Pipol wey well nor nid doctor, but na doz wey nor well nid am. Nor bi good pipol I kom koll, but na sinnas I kom for.”


Dis woman don sofa well-well for many doctor hand and e don spend all di money wey e get, but instead of am towel, di sickness kon dey worse more-more.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ