23 Wish kind sin I kommit sef? Wish kind bad tin I do? Wish kind wrong tin Yu sey I do?
I go tell God sey, ‘Before Yu kondemn mi, first tell mi wetin I do wey make Yu dey vex.’
Den wetin make Yu dey look for my sins and evry mistake wey I make?
No! Na bikos of yor sin and all di oda bad tins wey yu do.
‘I nor dey guilty; I neva do any bad tin or kommit sin.
“Okay! Make una tish mi; make una tell mi my fault and I go kwayet listin to una.
Yu nor fit just forgive mi my sins? Yu nor fit just sorry for all di bad tins wey I do? I go soon die and wen Yu dey look for mi, I go don go.”
Look mi well, den make Yu tell mi wetin I dey tink! Test mi and Yu go know wetin I wont!