17 Naw, make yu listin to wetin I dey try to tok; make yu open yor ear well.
E fit bi sey my boldness fit save mi, bikos know wiked pesin go try sey e won face God.
I don dey ready to komplain gi-am, bikos I know sey I dey rite.
So naw make yu listin to my words; listin as I dey beg.
“Make yu listin to wetin I dey tok. Dis na all di konfort wey I ask from yu.
“Nobody won listin to wetin I dey tok? I swear sey evry word wey I dey tok na true. Make God kom ansa mi. Make dem rite wetin my enemies tok about mi, so dat I go si dem.
“Job, make yu listin and hear evritin wey I won tok!