15 Even if E kill mi, I go still dey bilive am; I go still tell am wetin dey do mi!
Even doh Yu know sey I nor dey guilty, e nor get who fit save mi from yor hand.
I don dey ready to komplain gi-am, bikos I know sey I dey rite.
But I wish sey I fit tok to God, nor bi yu. I won make mi and God setol dis matter.
I dey pray to God from my heart, bikos I know sey I nor do any bad tin.
Abeg, I nid pesin wey go help mi beg God, just as pesin dey beg en friend.
Yet, God know evry step wey I dey take. If E sey make E test mi, I go klean kom out like gold.
I nor go ever agri with wetin una dey tok! I go stand for my rite till I die.
“Yu dey argue with God Almighty; yu don taya to tok or yu still get word to tell mi?”
Yu dey try to sey I dey wiked, bikos yu dey sey I dey wrong and yu dey rite?
My days just dey run kwik-kwik like moto; but for di end, I nor get hope.
Even doh I waka pass di place wey dark pass and where deat dey, I nor go fear anytin, bikos E dey with mi; en rod and staff dey protet and konfort mi.
Na trobol dey distroy wiked pipol, but doz wey dey fear God, go get life afta dem don die.
As Jonah dey inside di fish belle, e kon pray to God.
I go still dey happy and sing for joy, bikos na Oga God dey guide mi.
So, even if awa mind kondemn us, wi know sey God big pass awa mind and E know evritin.