So, di word wey God tok about Nebukadnezzar kon happen. Dem drive am komot from where human being dey and e kon go stay with animals. E chop grass like melu for seven years and dew fall for en body, until en hair kon long like eagle feada and en finger long like bird own.