20 E take di wisdom wey old pipol get kon silent doz wey dey advise odas.
E make leaders bi like fools kon make dem waka lost for desert.
Yu don klose dia mind, dem nor go fit undastand anytin, but make Yu nor let dem win mi.
Nor bi old age go make pesin wise or tish pipol how to undastand wetin dey rite.
Na mi make am nor get sense like dat! Na mi nor gi-am wisdom.
Many pipol dey gain from word wey betta pesin tok, but stupid word fit kill pesin.
Trut go last forever, but lie-lie nor dey tey before evribody go know sey na lie.
God hate pipol wey dey lie, but E like doz wey dey tok trut.