16 Na God get strent and wisdom; di pesin wey dey lie and di one wey dem dey lie give, all of dem dey God hand.
But God get wisdom and pawa. E know and undastand many tins.
Yu won use lie defend God? Abi all dis yor wayo argument na to help God?
If God look yu well-well, E go si any good tin for yor body? Yu feel sey yu fit fool God as yu dey fool human being?
But I don si am sey na God Almighty spirit dey enter and give human being wisdom.
Na God dey give wisdom! Na from en mout knowledge and undastandin dey from kom.
God wise well-well! E dey do just as E tok. E go ponish wiked pipol and doz wey dey enkourage pipol to sin.
“If any profet give una wrong massage, make una know sey na mi wey bi God do am like dat. But I go still rijet and remove am from among my pipol for Israel.
kon sey, “Make wi praiz God name forever and ever, bikos na-im get wisdom and pawa.
Nor allow us enter temptashon, but make yu save us from bad tins.’