12 Old pipol get wisdom? Abi long life nor dey bring undastandin?
King Rehoboam ask di old men wey bin dey advise Solomon, “Wetin una wont make I tell dis pipol?”
Wi learn and get awa sense from old pipol; pipol wey dem born before yor papa.
Elihu wey en papa na Barakel wey kom from Buz kon sey: “I know sey I small and yu don old and na dis make mi dey fear to tell yu wetin I dey tink.
I tell mysef sey make una tok, bikos una wey don old fit get wisdom wey una go share.
Make yu ask generashons wey don pass; tink and follow di trut wey dem sabi;