Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 11:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 God high pass di heavens; so wetin yu go fit do? E deep pass where dead body der; so wetin yu feel sey yu know?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 11:8
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God nor dey really stay with human being for dis eart! Si, if di sky and di heavens wey high pass nor rish Yu stay, den how dis temple go take kontain Yu?


God big pass di eart and E wide pass di sea.


God too dey big! E high pass di heavens and from der E dey look di stars as dem high rish.


Where dead body dey stay just dey open before God; nor-tin fit kover am from en eye.


Make una si how di kloud high rish! Make una look di sky well-well!


Wi nor fit kom klose to God, bikos en pawa big well-well! E always dey rite and korrect as E dey deal with us.


Anybody don ever show yu di gate wey dey guide where dead body dey?


As kloud dey vanish, na so who die nor dey kom back again.


As di sky high from di eart, na so too en love for pipol wey dey fear and serve am, big rish.


Make all of dem praiz God name. Bikos en name dey great and en glory dey shine for di whole eart and for heaven!


Yor goodness bi like di highest mountin and di way Yu dey judge, klean like river bottom. Yu protet both pipol and animals.


Who don go heaven kom back? Who don ever katch breeze for en hand or wrap wota for klot? Who kreate di whole world? Na who e bi and na wetin bi en pikin name? Make yu tell mi, if yu know!


As heaven high pass di eart, na so my ways and di way I dey tink, high pass una own.


Even if dem dig and hide for inside grave, I go still katch dem. And if dem klimb go heaven, I go bring dem kom down.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ