Even afta di ponishment wey don happen to us bikos of awa sin, wi still know sey Yu, awa God, dey sorry for us, bikos even doh Yu dey ponish us, Yu still help us survive am.
But, e get one God wey dey for heaven wey dey open sekret and tell dreams. E don tell King Nebukadnezzar wetin go happen for future. Dis na di dream and vishon wey yu si:
Di king sey, “Na yor God big pass among all gods! Na-im bi God of all kings and E dey show pipol wetin dey sekret and na-im make yu fit tok all dis tins so!”
Na di Oga awa God get all di sekret tins, but di tins wey E tell us, na for wi and awa shidren-shidren forever, so dat wi go fit obey all di words for dis law.