Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 11:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Yu feel sey yu words nor go make mi tok? As yu dey tok to God as yu like, so nobody fit tell yu sey wetin yu dey do nor good?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 11:3
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Even my friends dey laf mi naw; dem dey laf, but I know sey I nor do any bad tin. I bilive sey God go ansa my prayers.


Yu bi oga for lie-lie; yu bi like doctor wey nor fit trit pesin wey dey sick.


If God look yu well-well, E go si any good tin for yor body? Yu feel sey yu fit fool God as yu dey fool human being?


Na pipol wey dey laf mi dey round mi; e dey pain mi as I dey look how dem dey wiked mi.


Give mi shance make I tok and if I tok finish, yu fit laf mi, if yu like.


If nor bi so e bi, who go fit sey I dey lie or sey wetin I tok, nor bi true?”


Yu don si any man wey bi like Job wey dey tok anyhow?


Dem dey laf and koll mi difren names; while some dey try to bite mi.


My God, make Yu disgrace dem finish until dem bigin praiz yor name.


I nor dey spend my time to play and enjoy mysef with oda pipol. I dey always dey alone; dey obey yor word and I dey vex for evil pipol, bikos of wetin dem don do.


But if anybody nor obey awa message thru dis leta, make una look dat kind pesin well-well and make nobody follow am waka or do anytin togeda, so dat shame go katch am.


Make yu prish di trut, so dat pipol nor go get rizin to tok against yu. Den doz wey dey oppoz yu, go shame and dem nor go get word to tok about us.


Dem sey, “For di time wen dis world won end, some pipol go dey laf una and di tins wey God hate wey dey hongry dem to do, naim go dey push dem.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ