Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 11:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Yu nor go fear yor enemies again and pipol go dey kom beg yu for help.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 11:19
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So, Jehoshafat kon get peace, bikos God dey protet am for evry side.


Bikos wi get hope, yor life go dey well; God go protet and give yu rest.


E dey yuzles to work hard from morning go rish nite, bikos of wetin yu go chop. Yes! God dey provide for di pipol wey E love, even wen dem dey sleep.


I dey sleep with peace, bikos na only Yu wey bi my God, dey save mi.


Rish pipol from Tyre town go kom give una gifts. Doz wey get money go kom make una help dem.


Evribody dey try make dem gain favor for rish pesin front, just as evribody dey won bi friend to doz wey fit help dem.


Fear nor go katch yu wen yu dey sleep and yu go sleep well still day break.


Dem go abandon Siria town forever and animals go dey go chop grass for der and nobody go ever drive dem.


God tell Israel pipol sey, “Egypt, Sudan and doz tall pipol for Seba with evritin wey dem get, go bi una own. Dem go waka follow una with shains for dia leg; bow for una kon beg dey sey, ‘True-true, God dey with una and e nor get anybody wey bi like am. Yes! E nor get any oda god.’ ”


Doz wey bin dey opress una, dia sons go kom bow for una. All di pipol wey look down on una before, go kon woship una. Dem go koll una, ‘Oga God Town. Zion, di town wey Israel God wey dey holy dey stay.’


Di kountries wey hate dem nor go disturb dem again and wiked animals nor go kill or chop dem again. Dem go stay for peace and nobody go make dem fear again.


I go give una peace for una land and fear nor go katch una wen una dey sleep. I go kill all di wild animals for di land and war nor go dey der.


Evribody go stay for peace and dem go prosper. Dem go enjoy dia own grape and fig tree, bikos e nor get anytin wey go make dem fear. God wey dey mighty don promise!


Israel pipol wey remain, nor go dey sin again. Dem nor go lie and to deceive pipol, nor go dey dia mind again. True-true, dem go dey chop and sleep well and nor-tin go make dem fear again.


Listin! Doz pipol from Satan sinagog wey lie sey dem bi Jew, I go make dem bow for yor front, den dem go know sey I really love yu.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ