17 Yor life go shine pass aftanoon sun and di dark hours for life, go give yu morning lite.
For der wey all di pipol gada put, David praiz God kon sey, “God wey awa papa Jakob serve, wi praiz yor name forever!
Bikos wi get hope, yor life go dey well; God go protet and give yu rest.
Den yu go bilive God kon know sey na-im dey give happiness.
Yu go prosper for evritin wey yu dey do and lite go shine for yor way.
Dat time, God always dey with mi and E dey give mi lite wen I dey waka for darkness.
Even for darkness, lite dey shine for pipol wey dey fear God. Dem dey good, dey sorry for pipol and dem get respet.
E go show sey yu dey innocent kon defend yu for publik.
Dem go still dey produce fruit for old age! Dem go dey strong and fresh well-well.
Pipol wey dey fear God, lite dey shine for dia body and doz wey get pure heart, dey always happy.
Raitious pipol ways bi like sun for morning wey dey shine well-well go rish evening.
So make wi serve God. As far day dey break and rain dey fall for di eart, E go kom save us.
But for una wey dey fear my name, my sun wey dey give life go shine and heal una. Una go dey free kon dey happy like melu pikin wey dem open en kage make e for go play.