4 “Yu dey si tins di wey wi dey si dem? Abi Yu get di kind eye wey human being get?
God fit let dem stay for peace, but en eye nor go komot for dia body at-all.
bikos E dey si di end for di eart and E dey si evritin wey dey under di sky.
God dey si evritin wey wi dey do. E dey si evry step wey wi take.
If to sey God na pesin, I for ansa am. Wi for go setol awa matter for kourt.
But Jesus tell dem, “Na una dey make unasef good for pipol eye, but God know una heart. Bikos wetin human being value well-well, naim God nor like.
En head and hair white like wool, dem even white rish snow and en eyes red like fire wey dey burn well-well.
But God tell Samuel, “Make yu nor happy, bikos of how en face look, bikos nor bi en I choose. God nor dey si tins di way una dey si am. Pipol dey look pipol from how dem bi for outside, but God dey look pipol from how dem bi for dia heart.”