2 I go tell God sey, ‘Before Yu kondemn mi, first tell mi wetin I do wey make Yu dey vex.’
Wish kind sin I kommit sef? Wish kind bad tin I do? Wish kind wrong tin Yu sey I do?
I dey komplain give human being? If I nor dey komplain give human being, wetin go make mi kwayet?
Why yu dey akuiz God sey E nor dey ever ansa yor komplain?
“Yu dey argue with God Almighty; yu don taya to tok or yu still get word to tell mi?”
Yu wey dey wosh us, na wetin I do Yu? Abi I don sin against Yu? Why Yu dey target mi? I bi wahala to Yu?
If I dey guilty, wetin go make mi komplain?
Wetin go make pesin argue with God? E go fit ask God kweshon wey E nor go fit ansa?
My Oga God wey get pawa, make Yu protet mi, bikos of who Yu bi! Den kon save mi, bikos Yu dey faithful and good.
Make Yu nor judge mi yor savant, bikos evribody dey guilty for yor front.
Make Yu nor remember di sins wey I kommit wen I yong. Remember mi for di lite wey yor love wey nor dey fail dey bring, bikos Yu my God, dey sorry for pesin.
So my God, make Yu hear my prayer. Make Yu show mi mesi!
So, God nor go kondemn pipol wey bilive Jesus Christ.