I kon sey, “My own don finish, bikos evry word wey dey komot from my mout, na sin full am and I dey stay with pipol wey all dia words na sin and naw, I don use my eyes si Oga God wey bi di king wey get pawa.”
So my God, make Yu si as I dey sofa! My heart dey kry, bikos of my sins. Dem dey kill pipol for di street and even deat dey inside house too dey wait mi.
Na so too e go bi with una. Wen una don do all wetin dem send una, make una sey, ‘Na savant wi bi, wi nor rish make dem praiz us, bikos wi just do wetin wi suppose to do.’ ”