13 But na naw I know sey for all dat time, Yu dey plan to wound and kill mi.
Yu dey look to si weda I go sin, so dat Yu nor go forgive mi.
E neva shange and nobody fit oppoz or stop am from wetin E won do.
E go do wetin E don plan for mi. Na-im dey kontrol my destini.
Wen God dey work for nort and sout, I nor still si am.
True-true, na Yu bi Israel God and Savior and Yu bi God wey nor dey show yorsef.
Na mi kreate both lite and darkness; di Pesin wey dey bring blessing and wahala and na mi wey bi God, dey do all dis tins.
So, na who fit tok make sometin happen, if God nor allow am?
Who fit know how God big rish? Who fit know how God wisdom and undastandin bi? Who fit esplain why God dey do wetin E dey do!
Dis happen akordin to en plan wey go stand forever and E make am happen thru awa Oga God Jesus Christ
God sey, “Na Mi, bi Mi! And e nor get any oda god escept Mi. I dey kill and give life, I dey make pesin sick and heal pesin too and nobody go fit fight mi.