12 Yu don give mi life kon show mi yor love wey nor dey die. Na bikos yu kare for mi naim make mi still dey alive.
Una don do betta tin for mi and my family as una save awa life. But di mountins too far, before wi go run rish der, di fire go kill us for road.
Yu make my body with bone kon kover am with flesh and skin.
Na God Spirit make mi and na en breath give mi life.
“So I tell una, make una nor worry about una life, wetin una go chop or drink and wetin una go wear for body. Life nor big pass food? Abi body nor betta pass klot?
and E nor wont make human being gi-am sometin like sey E nid anytin, bikos naim dey give life and air wey wi dey breath.
Bikos na inside am wi dey live, waka, get life and some of una wey dey rite poem tok sey, ‘Wisef na God pikin.’