7 God ask Satan, “Where yu from dey kom?” Satan ansa, “I just dey waka anyhow for di world.”
Leta wen Gehazi go stand near en masta, Elisha kon ask am, “Gehazi, where yu go since?” Gehazi ansa, “I nor go anywhere o-o.”
God kon ask am, “Where yu from dey kom?” Satan ansa, “I just dey waka anyhow for di world.”
As di strong horse dem kom out, dem rush dey go patrol di eart. Di angel kon tell dem, “Make una go patrol di eart well-well!” So dem kon go.
“Wen evil spirit don komot from pesin body, e dey pass where wota nor dey, dey find where e go rest, but if e nor si,
Make una shine una eye well-well, bikos devil wey bi una enemy, bi like hongry lion wey dey shaut and dey find who e go chop.
Dis dragon na di old snake wey bi di devil or Satan, wey dey deceive di world. Dem trow am kom down from heaven with en angels.
and e go-go deceive pipol for di world; e go bring Gog and Magog togeda kon fight di war and dem go many like san-san for sea.