Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 1:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 E till get 7,000 sheep, 3,000 kamel, 500 oxen, 500 donkey wey bi woman, plenty savant and na-im get money pass for di east side for di kountry.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 1:3
34 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

and e trit Abram well, bikos of di woman. Abram kon kollect sheep and kattle, both man donkey and kamel.


Abram take en wife Sarai, en broda pikin Lot and evritin wey e get, plus di pipol wey dey with dem for Haran and all of dem kon go Kanaan land.


So di land nor big rish for di two of dem, bikos dem dey togeda and dia animals too many.


God don really bless my oga and e get evritin wey e wont. Oga God don gi-am sheep, kattle, gold, silva, man and woman savants, kamel and donkey.


But wen Abraham still dey alive, e give gift to di shidren wey en oda wifes born for am kon send dem go east, so dat dem go dey fast and nor disturb Isaak.


So Jakob kon dey travel until e rish di land where pipol dey for east.


Di present na two hundred woman goat, twenty man goat, two hundred iyu, twenty ram,


If wi do wetin dem tok, all dia animals and propaty go bi awa own. Make wi just gri with dem and dem go stay with us.”


Solomon get sense pass di wise men for east and for Egypt.


Menahem kollect di silva from di rish pipol wey dey Israel. E take fifty-fifty silva from all of dem kon gi-am to Assyria king. Den Assyria king komot dia land and e nor kom back again.


King Mesha for Moab dey barb sheep hair and e dey always give Israel king 100,000 lamb and 100,000 rams wool,


Na Obil wey kom from Ishmael tribe, dey keep di kamel; Jehdeaya from Meronot dey keep di donkeys, while


E still build towas wey e fence; dig many well for di desert, bikos e get many animals for di hills and plain land. E get pipol wey dey work for am for en farm, vineyard, di hills and for Mount Karmel, bikos e like farm work well-well.


E build royal towns and e get many sheep and melu, bikos God gi-am many propaty.


Yu dey kover en, en family and all di tins wey e get; Yu bless evritin wey e dey do and Yu don gi-am plenty animals.


Job sons dey always do party one-by-one for dia house, wey evribody dey kom chop and drink and dia three sistas dey kom too.


Yu go soon tell mi about rish and wiked pipol wey dia house don vanish bikos of sin.


I dey lead dem as king dey lead many pipol kon konfort dem wen dem dey face trobol.


or kom dey karry body, bikos of di money wey I get.


I go dey proud to tell God evritin wey I don do. I go waka go meet am like prince.


Afta Job don pray for en friends, God kon make am rish for evry side again and E gi-am taims-tu of evritin wey e lost.


God bless di remainin days wey Job stay for dis eart pass wen dem born am. Job kom get 14,000 sheep, 6,000 kamel, 2,000 kattle and 1,000 donkey.


Wen God bless pesin, e dey get enough and nor-tin go make am regret.


Dis na wetin God tok about Kedar and Hazor kingdom, wey King Nebukadnezzar for Babilon, win: “Make una katch Kedar pipol kon distroy doz wey dey east!


Den Balaam profesai kon sey: “King Balak for Moab bring mi kom from Aram, from di mountin wey dey di east kon sey, ‘Make yu kom help mi curse Israel pipol.’


Anytime wen Israel pipol plant, Midian, Amalek pipol and anoda tribe for di desert go kon attack dem.


Dem go kom with dia kattle and tent wey tick like lokust. Dem go use dia kamel take skata di land


Midian and Amalek pipol and di men wey dey stay di desert, many for di valley like worm and dia kamel many like san-san for wotaside.


By dat time, Zebah and Zalmunna and dia soja, dey Karkor. Dem bi only 15,000 wey remain from all di men wey dey di desert tribe and dem don kill 120,000 of dia soja.


E get one man for Maon and e dey sell for Karmel town. Dis man get money well-well; e get 3,000 sheep and 1,000 goats. Dat time, e dey barb en sheep hair for Karmel.


Anywhere David attack, e dey kill evribody finish. E go take dia sheep, kattles, donkeys, kamels and all dia klot, den e go-go back go meet Akish.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ