As Elisha dey look, e kon dey shaut, “My papa, my papa, di shariot and sojas for Israel!” So e nor ever si Elijah again. Elisha kon tear en own klot to pieces.
Wen evribody for Israel si sey fire kom down and God present full di temple, dem knee down kon face groun. Dem kon dey woship and tank God dey sey, “True-true, God dey good; en love wey nor dey fail, go dey forever!”
So, Jerusalem pipol! Make una mourn and kut una hair. Make una sing burial song on-top evry hill, bikos God sey, ‘I go rijet and forget dis pipol, bikos dem don make mi vex.’ ”
Nor bi just to tear una klot, but make una heart show sey una don turn from sin kom meet mi.” Make una kom back kon meet di Oga wey bi una God. E dey kind and dey show mesi; E dey patient and dey keep en promise; E always dey ready to forgive and nor bi to ponish pipol.
E waka go front small kon liedan face groun, den e kon pray, “My Papa, if yu wont, yu go fit remove dis deat from mi! But nor bi as I wont, na as yu wont am.”
Den I go stay for God present for anoda forty days and forty nite; I nor chop or drink anytin bikos of all di sins wey una don kommit wen una dey do wiked tins wey go make God vex well-well.