2 E born seven sons and three dotas.
E kon dey boast give dem sey e get money well-well; many sons; how di king don promote am and how e dey important to di king pass any oda offisa.
Make yu shut up yor mout, so dat I go tok. Wetin go bi, go bi.
Afta Job don pray for en friends, God kon make am rish for evry side again and E gi-am taims-tu of evritin wey e lost.
God bless di remainin days wey Job stay for dis eart pass wen dem born am. Job kom get 14,000 sheep, 6,000 kamel, 2,000 kattle and 1,000 donkey.
Job kon still born seven sons and three dotas.
E bless dem, so dat dem go born kon plenty for di land and na so too E make dia animals plenty.
Yor wife go bi like vineyard wey get betta fruit and e go prosper for yor house. Yor shidren go bi like yong olive tree.