Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jeremaya 9:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 I still sey, “Naw, wimen! Make una listin and hear wetin God dey tok. Make una tish una dotas and friends how to kry and sing beri song.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jeremaya 9:20
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make yu follow di tins wey E dey tish kon keep en words for yor heart.


God sey, “Si how Jerusalem wimen dey karry body up! Dem dey waka dey karry dia head up and roll dia eyes. Dem dey waka small-small make dia shain for dey make nois.


God sey, “I go make yong pipol rule dem and na wiked yong men go bi dia oga.


And di pipol wey dis fake profets dey profesai to, na war and honga go kill dem too. Dem go trow dia dead body for evriwhere for Jerusalem street and nobody go dey to beri dem. Dis tin go happen to all of dem, dia wifes and dia shidren. I go make dem pay for all di bad-bad tins wey dem dey do.”


God wey dey mighty still tell Jerusalem pipol: “Make una nor listin to wetin doz lie-lie profets dey tell una; na yeye hope dem dey give una. Nor bi wetin I tell dem, dem dey tell una, but na wetin dem tink and like, dem dey tok.


Make di profet wey dream, tok only wetin e dream and make di profet wey hear my message, tok di trut. Nobody fit use tree kanda kompare di main tree.


My Oga God, just as Yu dey vex for dem, na so too I dey vex and I nor fit hide my vexnashon again.” Den God sey, “Di shidren wey dey play for di street and di yong men wey gada togeda, make yu pour my vexnashon for dia body. Dem go seize and karry husband and wife go and dem nor go even sorry for old pipol.


So, Jerusalem pipol! Make una mourn and kut una hair. Make una sing burial song on-top evry hill, bikos God sey, ‘I go rijet and forget dis pipol, bikos dem don make mi vex.’ ”


Den, put dem under sun, moon and stars. Bikos dis na di tins wey dem love; tins wey dem dey woship, serve and koll make e kom guide dem. Nobody go gada dis pipol bones go beri again; so dem go bi like manure wey dem pour for groun.


So I ask, “Na who wise rish to undastand wetin make dis tins happen? Na who God don tell wey fit esplain why e bi like dis? Wetin make di land skata kon dry like desert wey pipol nor fit travel pass?”


Wake-up for nite, make yu kry. Pour all yor heart like wota before God! Raiz yor hand as yu dey pray to am and dey beg for yor shidren wey dey faint, bikos honga won kill dem.


Si yong and old pipol don die for di street. Enemies don kill both boys and girls. Yu don kill dem, bikos Yu dey vex and Yu nor sorry for dem wen Yu dey kut dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ