Den God tell mi, “Even if Moses and Samuel stand here dey beg for dis pipol, I nor go listin or sorry for dem. So make yu take dem komot for my front kon tell dem make dem dey go!
Yes, di enemies go kom like kloud. Dia shariot bi like strong breeze and dia horse fast pass eagle.” Den I kon kry, “Wi don die finish o-o, bikos dem go distroy us!”
So, Jerusalem pipol! Make una mourn and kut una hair. Make una sing burial song on-top evry hill, bikos God sey, ‘I go rijet and forget dis pipol, bikos dem don make mi vex.’ ”
Naw, pipol dey shaut for dem anyhow sey, “Komot for here! Una wey dey smell! Make una nor tosh us!” So dem kon komot der go anoda town, but any town wey dem waka go, di pipol dey porshu dem.
Wen dat time rish, pipol go use una as song take esplain how wahala bi and dem go use una wahala take dey sing sey: “Awa own don finish kpata-kpata! God distroy, take awa land from us kon gi-am to awa enemies.”
For aftanoon, una go dey find road to pass like blind pipol and doz wey dey darkness and una go dey fail for evritin wey una dey do. Pipol go always dey tif una tin and opress una and nobody go save una.