Wen dem sidan make dem bigin chop, dem kon si some karavan wey karry Ishmael pipol dey kom from Gilead. Dia kamel karry spice, balm and myrrh dey go Egypt.
Den dia papa Israel tell dem, “If na so e go bi, den make una do dis tin for mi: Make una karry some among di best tins wey wi get put for una bags kon give di man as gift; small balm, honey, spices and myrrh, pistachio and almond.
Den I sey, “My God, Yu don forget Judah pipol? Na so Yu hate Zion town? Wetin make Yu dey do us like dis, sotey wi nor dey okay again? Wi dey hope for peace, but na wahala wi dey si. Wi dey bilive sey wi go well, instead na trobol dey follow us.
Just as well dey bring fresh wota kom out, na so too Jerusalem dey bring all en wikedness kom out. I dey hear war and distroshon nois for di town kon si wound and sickness for evriwhere.
I wish sey my head bi like well wey wota full and my eyes bi like fountain where wota for dey rush kom out, den I go kry well-well both day and nite for my pipol wey dem kill.
Wetin I go fit tok? Who don ever si dis kind sofa before? Wetin I go fit take kompare yu, Jerusalem? How I go fit take konfort yu? Bikos di wound wey yu wound, deep like sea. Na who go fit heal yu?