Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jeremaya 8:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Dem dey shame sey dem do dis kind wiked tins? ‘No!’ Dem nor dey shame at-all; dem nor even sabi form sef! Bikos of dis, just as pipol wey don die, na so too dem go die finish afta I don ponish dem.” Mi, wey bi God, don tok.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jeremaya 8:12
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di next day, di senior dota kon tell en sista sey, “I sleep with papa yestiday nite; so make wi gi-am plenty drink today again, so dat yu go sleep with am.”


Yu wey tink sey yu strong, why yu dey karry body for di bad tins wey yu dey do? Yu nor know sey God love dey always protet mi?


“Si wetin happen to dis man wey nor trust God and tink sey e strong. E trust en money kon dey happy for di wiked tins wey e dey do.”


Evribody go sofa; priests and pipol; slaves and dia oga dem; pipol wey dey buy and sell; pipol wey dey borrow odas money and doz wey dey borrow from dem; plus rish and poor pipol: all of dem go sofa di same tin.


Dia face dey show sey dem dey guilty. Just like di pipol for Sodom, na so too dem dey boast about dia sin. E bad well-well for dem, bikos dem dey distroy demsef.


Di juju dey yuzles, so make dem distroy dem trowey and time dey kom wen God go ponish and distroy all of dem.


I nor send doz profets, even doh dem dey lie with my name. Dem fit dey sey, ‘War and honga nor go dey for di land.’ But dis na wetin mi wey bi Oga God dey tok about dem: ‘Na war and honga go kill doz profets.’


So di road wey dem dey pass, go dark and go dey draw; I go make dem kick stone fall. I go bring wahala kom meet dem and di time to ponish dem, don near. Mi, wey bi God, don tok.”


Bikos of dis, God nor allow rain fall, even for di rite time. With all dis tins, una still dey live una ashawo life and shame nor dey katch una.


But till naw, una neva gri honbol unasef. Una neva honor mi or live una life as I kommand una and una grand-grand papa.


Shame dey katch dem bikos of di wiked tins wey dem do? No! Dem nor dey shame at-all. Dem nor even sabi form sef! So, dem go die just as odas die. Dem go die finish, afta I don ponish dem.” Mi, wey bi God, don tok.


So God sey, ‘I go send sojas kom distroy dem. Papa, mama and shidren go die, even friends and neighbours go die too.’


E naked kom out kon let evribody know sey e bi ashawo. I vex for am, just as I vex for en sista.


Bikos Judgement Day dey kom wen dem go distroy Israel pipol. Wetin I dey tok naw, go really happen to una!


But God still dey di town and E nor dey do bad at-all. E dey always judge matter well and E nor dey fail. Yet wiked pipol nor dey shame at-all.


I go revensh and pay dem back wen dem go fall, bikos di day wen wahala go kom meet dem, don near well-well and dia judgement don almost full!”


Dem go end for hell; na dia belle bi di god wey dem dey serve. Tins wey suppose make dem shame, naim dey make dem happy and na only tins for dis world dem dey tink about.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ