Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jeremaya 51:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Babilon pipol bi like gold cup for my hand a nd di wine for inside dey shark di whole world. Di nashons drink from am and dem kon start to bihave anyhow.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jeremaya 51:7
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

dem go laf Babilon king kon sey, “Make una si as evritin take end for di king wey dey opress pipol! E nor go ever fit opress anybody again!


Den, yu go tell dem, ‘All di pipol wey dey dis land, God go give dem wine drink until di wine don katch dem: both di kings wey kom from David family, di priests, profets and all Jerusalem pipol.’


‘I go koll di pipol wey dey nort and my savant King Nebukadnezzar for Babilon and dem go kom fight against Judah pipol and di towns wey dey round Jerusalem. I go distroy and skata dis nashon and di ones wey dey round am, forever. I go make pipol si and dey fear dem.


Wahala go kom di land and all di rivers go dry finish. But, wetin make all dis tins dey happen? Na bikos juju full di whole land and di pipol love dem well-well.


Pipol wey nor kare dey der dey shaut and na wildaness dem from bring dis pipol. Dem put shain for di wimen hand kon wear betta crown for dia head.


Na gold dem take make di image head; en chest and hand na silva, while from en belle go down, na bronze.


E don make yu ruler ova human being, animals and birds for dis eart. Na yu bi di head among all gold.


Anoda angel follow di first one kon sey: “E don fall! Babilon don fall! Babilon wey make all di kountries drink di wine wey make dem dey sleep with who dem nor marry.”


Di kings for eart dey sleep with am and en sin don shark dis world pipol like wine.”


Di woman wear purpol and red klot kon wear gold for neck. E wear stones and beads wey dear. E hold one gold cup for hand and na yeye tins with sins full inside.


Even lantan lite nor go ever shine inside yu again! Dem nor go ever hear sey man and woman dey marry inside yu again. Na yor tradas get pawa pass for dis world, bikos yu take yor majik deceive all di oda kountries!


Bikos en sin bi like drink wey dey shark pesin and na-im make dem dey sleep with who dem nor marry. Na dis make am fall and all di kings for dis eart don sleep with am and many tradas don get plenty money, bikos of di yeye life wey e dey live.”


bikos en judgement dey true and korrect. E don ponish dat ashawo wey spoil di world with en sins, as e dey sleep with who e nor marry and God don revensh am for Christ savants wey e kill!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ