Jeremaya 50:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
13 Afta I don vex ponish Babilon, nobody go stay der again. Dem go distroy am finish. Doz wey dey waka pass go si am kon sopraiz well-well, bikos of di wahala wey don happen to am.
Bikos mi God don sey, I go orda dem and dem go kom di town again. Dem go attack, seize and burn am rish groun. I go turn Judah town to desert where nobody dey stay.’ ”
Na from nort one nashon go kom attack and distroy Babilon. Babilon go turn desert where nobody dey stay, bikos en pipol and animals go run komot der.’ ”
Dis na di find town wey dem guide well-well before. Di town bin dey boast sey, “Na mi great pass! E nor get any town wey bi like mi!” But naw, si as e don turn where dem dey trowey dirty put and na wild animals dey stay der naw. Evribody wey dey pass der, dey laf and shake dia head bikos of am.
“En shidren-shidren wey go kom afta una, plus di strenjas wey go kom from far place, all of dem go si di wahala for dat land and di sickness wey God go send for dia head.