Na mi big pass for dis house and my oga don give mi evritin escept yu, bikos yu bi en wife. So wetin go make mi do dis kind wikedness kon sin against God?”
Jerusalem pipol! I don si as una dey do ashawo waka and as una dey run follow difren juju for fields and for evry hill. Naw, make una si di wahala wey dey wait una. So, una go ever dey klean to woship mi again?
Na pipol wey nor dey faithful, full di land and dem dey live wiked life kon dey use dia pawa anyhow. Di pipol dey mourn and all di green leaf don dry, bikos God don curse dia land.”
Dis na wetin go happen to dem, bikos dem sin: dem sleep with dia neighbour wife kon lie with God name. God nor like all dis tins. E know wetin dem don do and wetin dem do dey stand against dem.” Dis na wetin God tok.
God sey, “Babilon pipol! Una tif from my pipol and e dey make una happy. Una dey enjoy like animal wey dey chop betta green grass. Una dey sing with joy like di nois wey horse dey make.