Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jeremaya 5:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jeremaya 5:31
37 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So King Ahab koll almost 400 profets kon ask dem, “Make I go attack Ramot for Gilead or not?” Dem ansa, “Make yu go attack am, bikos God go make yu win.”


Wiked pipol dey listin to bad advise and doz wey dey lie, dey listin to lie-lie.


Naw, wetin una go do wen God won judge una? Wen God bring wahala from far kountry kom meet una, na who una won run go meet make e help una? Where una go hide una propaty and money put?


For dat time, pipol wey dey stay near di river go sey, ‘Si wetin don happen to di place where wi bin put awa hope; so na where wi go run go make dem help us naw? Na where wi dey espect sey, wi go dey save from Assyria king? How wi go fit take eskape naw?’ ”


Zion pipol wey dey sin, dey fear! Pipol wey nor dey fear God, dey shake. Dem sey, “E get any one of us wey fit survive dat kind fire?”


Una grand-grand papa dem wey dey before, kommit sin. Una leaders sin against mi and una rulers stain my temple with blood.


Yu sey, ‘I go bi kween forever.’ But yu nor tink about dis tins or tink about wetin go happen.


Na how long awa land and di grass for di farm go dey dry? Awa animals and birds dey die, bikos of dis pipol wikedness! Pipol wey sey, ‘God nor dey si wetin wi dey do.’ ”


But God ansa, “Doz profet dey lie with my name; I nor send dem or tell dem sey make dem tell di pipol anytin. Nor bi mi give dem di vishon wey dem dey tok about and wetin dem tok, na di yuzles tins wey dem tink for dia own mind.


As I dey tok for God temple, di priests, profets and di pipol, dey hear mi.


E nor keep ensef klean or tink of wetin go happen to am. Naw, e dey inside gutta and nobody won bring am out. So e kry kon sey, “Oga God, make Yu si wetin dey happen to mi; my enemies don win mi.”


Yor profets dey lie for yu kon sey dem si vishon. Na dem make una go Babilon, bikos dem nor tell una about una sins. Instead, dem make una tink sey una nor nid to turn from una sin kom meet God.


But dis tin happen, bikos of di sin wey di profets and di priests kommit and bikos of di innocent pipol for di town, wey dem kill.


Awa enemies dey wosh awa movement and naw, wi nor fit waka for di street again. Awa days for dis world don almost finish, bikos wi go soon die.


“Di profets deceive my pipol wen dem tell dem sey evritin dey okay. But evritin nor dey okay at-all! My pipol don build wall with stones wey nor strong and di profets kon paint am fine for dem.


Dia vishon na lie and anytin wey dem tok sey go happen, nor dey happen. Dem dey sey na my message dem dey prish, but I nor send dem and dem dey espect sey wetin dem tok, go happen!


Wen I don finish with una, una tink sey una go get strent or pawa to karry una hand? Mi God don tok and I go do wetin I tok.


Dem go sofa di same ponishment with di pipol! I go ponish and make dem pay for di evil and wiked tin wey dem do.


I don si wiked tins for Israel: Judah pipol don make demsef dirty, bikos dem dey woship juju.


So na wetin una go do wen festival time rish? How una go take do Oga God festival?


If lie-lie profet kon tell una sey, “Make una dey drink wine and plenty strong drink!” Una go happy, bikos dat na di kind profet wey una dey like!


But di pipol tell mi, “Make yu nor tok like dat. Nor prish like dat, bikos dat kind wahala nor go ever happen to us!”


Una leaders nor dey judge well, bikos dem don take bribe and una priest dem dey do dia work, bikos of money. Una profets nor dey profesai unless dem first pay dem. Yet all of una sey una trust God. Una sey, “Nor-tin go happen to us, bikos God dey with us.”


En profets sturbon and dem dey lie; dey tok only wetin go give dem money. En priests nor gri obey God kommand, so dem don spoil and make di temple dirty with di bad tins wey dem dey do.


God sey, “I go rijet dem, I go si wetin go happen to dem; bikos dis generashon dey show sey dem too know and dem nor get sense.


How I wish sey dem get sense and fit undastand dis tins or know wetin go happen to dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ