20 God sey, “Go tell Jakob shidren-shidren and all Judah pipol sey:
God sey, “Blow di trumpet for di land! Shaut kon gada evritin togeda! Den tell Judah and Jerusalem pipol sey, make dem run go stay di strong towns.
So Jeremaya, anytime wey yor pipol ask, “Wetin make di Oga God ponish us like dis? Make yu ansa, ‘Na bikos dem leave God go woship oda gods for dia land and bikos of dat, una must go serve as slave for anoda land.’ ”
Make una listin, ‘Una bi fool and una nor get sense. Una get eye, but una nor dey si; una get ear, but una nor dey hear.’ ”