Den Dibon pipol go klimb di hill go kry for dia shrine bikos of wetin happen to Nebo and Medeba town. Moab pipol go kry well-well. Evribody go barber bololo kon shave dia bear-bear.
Rish and poor pipol go die for dis land and nobody go beri or mourn for dem. Pipol nor go kut dia body or shave dia hair to show sey dem dey mourn for dem.
eight men kom from Shekem, Shiloh and Samaria. Dem don skrape dia hair, tear dia klot kon kut demsef to show sey dem dey mourn and dem karry korn and incense go offa for di temple.
Di time don rish wen dem go distroy Filistia pipol kon stop doz wey dey help Tyre and Sidon. Mi wey bi God go distroy Filistia pipol and all di pipol wey kom from Krete wotaside.
Judah pipol, make una mourn and shave una hair, bikos dem go karry di shidren wey una love go as slave. Make una skrape una head like vulture own, bikos dem go karry una small-small shidren go work as slave for anoda land.