Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jeremaya 42:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 ‘If una ready to stay for dis land, I go build una up and una nor go skata again; I go plant una and nor-tin go fit rut una again. Na pains and sorrow full my heart, bikos of di wahala wey I kause for una.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jeremaya 42:10
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen Oga God angel won distroy Jerusalem, God kon shange en mind sey E nor go ponish di pipol again, so E tell di angel wey dey kill dem, “Make yu stop! E don do!” Dat time, di angel dey Araunah wey bi Jebus pesin farm.


bikos E go ribuild Jerusalem kon appear inside en glory.


E remember en kovenant with dem kon sorry for dem, bikos of en love wey nor dey fail.


Make yu trust God and do wetin dey good, den yu go get peace for di land and yu go prosper.


Bikos God go diliver Zion kon ribuild Judah town and en pipol go stay der again kon take-ova Zion.


God shange en mind, so E nor kon ponish en pipol again.


I go kare for dem kon bring dem kom back to dis land. I go karry dem up and nor-tin go fit bring dem down. I go plant dem and nor-tin go fit rut dem.


“King Hezekaya and di pipol nor kill Mikaya, abi dem kill-am? But King Hezekaya honor God kon try to win en favor. So, God kon shange en mind and E nor distroy dem again. But as e bi so, wi dey won kause sirious wahala for awasef.”


But if any nashon gri kon serve Babilon king, I go make dat nashon stay and chop from en own land. Mi, wey bi God, don tok.” ’ ”


And just as I make sure sey dem rut, pul, ova-trow, distroy and skata dem, na so too I go make sure sey dem plant and build dem back again.


I go make Israel and Judah pipol prosper and I go build dem as dem bi before.


So Johanan, di sojas offisa and di oda pipol nor gri stay for Judah, just as God kommand dem.


Den di nashons wey dey near der, wey survive, go know sey mi wey bi God don ribuild dis town wey skata before kon plant put for di field wey bin dey empty. Mi wey bi God don promise sey, I go do wetin I sey I go do.”


Efraim pipol, how I won take leave or abandon una? I nor fit distroy una just as I distroy Admah pipol or trit una as I trit Zeboiim pipol? My heart nor go let mi do am, bikos di love wey I get for una, too strong.


Nor bi just to tear una klot, but make una heart show sey una don turn from sin kom meet mi.” Make una kom back kon meet di Oga wey bi una God. E dey kind and dey show mesi; E dey patient and dey keep en promise; E always dey ready to forgive and nor bi to ponish pipol.


So God shange en mind kon sey, “Wetin yu si, nor go happen again.”


So God shange en mind again kon sey, “Dis one nor go happen too.”


So wen God si wetin dem dey do: sey dem don really turn kom meet am, E kon shange en mind and E nor ponish dem again, just as E bin won do.


For di day wen Jonah enter di town, e kon tell di pipol, “Afta forty days, God go distroy Nineveh finish!”


Den e kon dey komplain to God, “My God, before I komot from my kountry, I know sey dis na wetin Yu go do? Na dis tin make mi try to run go Tarshish! I know sey Yu dey sorry and kare for pipol and Yu get patient, dey kind and instead of Yu to ponish pipol, Yu always dey ready to forgive dem.


“ ‘Afta all dis tins, I go kom back and I go build David house wey don fall; I go build am with all di san wey skata for groun and e go strong again,


God go judge en pipol and E go shange en plan about en savant; wen E si sey dia pawa don vanish and nobody remain again, weda na slave or free pesin.


As long as di leaders wey God give di pipol dey alive, E help and diliver dem from dia enemies. God sorry for dem well-well wen dem kry to am with pain, bikos of wetin dia enemies dey do dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ