Jeremaya 38:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
2 “God sey, ‘Anybody wey stay for di town go die for war or honga or diziz go kill-am. But di pipol wey go-go surenda give Babilon pipol, nor go die; dem go eskape with dia life.’ ”
“ ‘But King Zedekaya for Judah, en ofisas and di pipol wey remain for dis land and doz wey go Egypt, mi wey bi God, go trit dem like dis bad fig wey don spoil.
But make una listin to wetin God tok about di king wey dey rule David kingdom and di pipol for di town wey bi una relashon, wey dem nor karry as prisonas follow una.
“Naw, mi wey bi God sey, ‘Una don disobey mi; una nor gri free una brodas and sistas. Since na like dat, I go free una so dat war, honga and diziz, go kill una. I go make evry nashon for di world fear for wetin I go do to una.
Na war, honga and diziz go kill all di pipol wey gri sey dem won go stay Egypt. No one among dem go survive or eskape di wahala wey I go bring for dem.’
Yu dey find betta tins for yorsef? Make yu nor worry yorsef, bikos I won bring wahala kom dis world. But anywhere wey yu won go, I go let yu go and I go save yu.’ ”
Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “I go send my four worse ponishment kom Jerusalem and dem bi: war, honga, wiked animals and diziz. I go send dem kon distroy di pipol and dia animals.
God still sey, “Make yu klap yor hand! Mash di groun well-well! Cry with pain kon sey, ‘Bikos of all di wiked and bad tins wey Israel pipol don do, dem go die for war or honga and diziz go kill dem trowey.
Pipol go dey fight each oda for street, but for house, na sickness and honga go dey der. Anybody wey dey outside di town go die for di fight and evribody wey dey house, na sickness and honga go kill dem.