Judah pipol gods plenty, just as di towns wey dem get. And as Jerusalem street plenty rish, na so too di altar wey dem build for Baal juju, plenty too.
“So, mi wey bi Israel God dey ask, ‘Wetin make una dey distroy unasef? Nobody among una wey kom here from Judah go survive: weda na man or woman, pikin or di shidren wey dem just born. Dem go distroy all of una finish.
Awa enemies don already dey Dan town; wi dey hear dia horse nois and as di whole town dey shake. Awa enemies dey kom distroy awa land. Dem dey kom distroy awa town and evribody wey dey inside.”
God sey, “Wen I first si Israel, e bi like wen yu si grape wey dey grow for desert. Wen I first si una grand-grand papa dem, e bi like wen yu first si ripe fig for en sizin. But dem go meet Baal for Peor kon dey woship am and dem kon bi like di juju wey dem love.