Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jeremaya 22:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 But I swear sey, if una nor obey my kommand, dem go distroy dis palis rish groun. Mi, wey bi God, don tok.” ’ ”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jeremaya 22:5
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

kon tell am, “God sey, ‘I promise yu with my own name sey, bikos yu don do like dis kon give mi yor son, yor only pikin,


But if yor pipol turn from mi kon dey disobey di rules and kommand wey I sey make dem keep and dem kon dey serve anoda god,


But for dis temple, wey bin dey good and okay, evribody wey dey pass am go shok kon sey, ‘Wetin make God do like dis to dis land and dis temple?’


Odas go ansa sey, ‘Na bikos dem nor obey di Oga wey bi dia grand-grand papa God; di One wey take dem komot from Egypt. Dem dey serve and woship oda god with all dia mind. Na dis make God dey ponish dem like dis.’ ”


So I kon swear as I dey vex sey: ‘Dem nor go ever enter my place where rest dey.’ ”


But if una sin against mi, una go die. Mi, wey bi God, don tok.”


God still sey, “I don forget Israel pipol and rijet di nashon wey I choose. Doz wey I love, I don give dem to dia enemies.


But una must obey mi kon make di Sabat, holy. For dat day, una must nor karry any load pass Jerusalem gate, if una do am, I go burn di gate rish round. Fire go burn di palis rish groun too and nobody go fit kwensh am.’ ”


Tell dem sey di Oga wey bi God sey, ‘Una must obey mi and do wetin I tish una.


By dat time, Babilon sojas don burn di royal palis and all di house wey dey Jerusalem rish groun, den dem kon skata di wall.


But naw, make una listin to di promise wey mi, God make with my strong name and dis promise na for Israel pipol wey dey Egypt: ‘I nor go ever let una use my name take make promise again or sey, “I swear with God wey get pawa!”


Oga God wey get pawa don warn una well-well sey, “I hate as Israel pipol proud rish; I hate di strong and big-big house wey dem get. I go give dia main town and evritin wey dey inside, to dia enemies.


So, bikos of una, I go klear Zion like field; Jerusalem go bi where dem dey trowey dirty put and di temple go turn hill wey grass grow kover.


Si, from today go, una go skata and una house go empty.


Na who God swear for sey, dem nor go ever get rest, nor bi doz wey disobey am?


Nobody big pass God, bikos God swear with en name wen E promise Abraham sey,


So wen God won show en pipol sey E nor go break en promise, E kon swear with ensef.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ