So Oga God sey, “I go distroy human being wey I kreate komot for dis eart; plus evritin, from human being go rish animals, join di ones wey dey creep for groun and di birds for di sky, bikos I dey vex sey I kreate dem.”
I kon ask, “Oga God, how long dis tins go take happen?” E ansa, “Na till di town skata finish and nor-tin go dey inside again. Till nobody dey stay di house and na until di land don turn where dem dey trow dirty put.
Even if dem fast, I nor go listin to dia kry for help and if dem offa burnt and korn ofrin, I nor go asept am. Instead I go kill dem for war and with diziz and honga.”
Na wiked diziz go kill dem and nobody go mourn or beri dem. Dia dead body go full groun like manure. Na war and honga go kill dem, den bird and wiked animals go chop dia dead body.
God sey, ‘I go make yu dey fear yorsef and yor friends go dey fear yu too. Yu go dey si as dia enemies go kill dem finish. I go make Judah pipol serve Babilon king and e go take some of dem go en kountry as slave kon kill di odas.
Si as Babilon pipol build dia kamp round di town and dem won seize and attack am. Dem go win, bikos war, honga and diziz don already dey kill yor pipol. Naw, make Yu si sey evritin wey Yu tok, don dey happen.
God wey mighty sey, “Dis land wey bi like desert where pipol or animals nor dey stay, I go turn am to where fresh green leaf go dey and shepad go take dia sheep go chop for der.
“Naw, mi wey bi God sey, ‘Una don disobey mi; una nor gri free una brodas and sistas. Since na like dat, I go free una so dat war, honga and diziz, go kill una. I go make evry nashon for di world fear for wetin I go do to una.
God sey make I tell di king: “Yu don burn di book kon dey ask Jeremaya, ‘Why yu sey Babilon king go kom distroy dis land, kill evribody and all di animal?’
So, di Oga God sey, “I go pour my vexnashon for dis land. I go pour am put for both pipol and animals body and even di trees and food wey dem plant. My vexnashon go burn like fire and nobody go fit kwensh am.”
But I go let some of dem survive di war, honga and diziz, so dat dem go tell di nashon where dem dey stay naw, about all di yeye tins wey dem do. Den, dem go know sey na mi bi God.”
Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “I go send my four worse ponishment kom Jerusalem and dem bi: war, honga, wiked animals and diziz. I go send dem kon distroy di pipol and dia animals.
“Go tell dem sey mi, God dey warn dem sey, ‘As long as I bi di God wey dey alive, di pipol wey dey stay for di main field, go die. Wiked animals go chop doz wey dey stay for di kountry and na diziz go kill doz wey hide for mountin and whole.
Pipol go dey fight each oda for street, but for house, na sickness and honga go dey der. Anybody wey dey outside di town go die for di fight and evribody wey dey house, na sickness and honga go kill dem.
I go swip both pipol and animals. I go distroy di birds for di sky and di fish for sea. I go turn wiked pipol place to where dem dey trowey dirty put kon distroy human being komot from dis eart.
Dem go use swod kill some, karry some as prisona go anoda kountry and di Gentile pipol go distroy Jerusalem, until di time wey God sey Israel must sofa, go end.