Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jeremaya 21:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Bikos I don make up my mind sey I nor go sorry for dis town, so I go distroy am. I go gi-am to Babilon king and e go burn am rish groun. Mi, wey bi God, don tok.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jeremaya 21:10
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem burn God Temple kon skata Jerusalem wall. Dem burn all di towns wey dem fence kon distroy all dia betta-betta tins.


But God dey trowey en face from doz wey dey do bad tins; E dey remove dem from dis eart.


But una must obey mi kon make di Sabat, holy. For dat day, una must nor karry any load pass Jerusalem gate, if una do am, I go burn di gate rish round. Fire go burn di palis rish groun too and nobody go fit kwensh am.’ ”


If una nor gri obey mi, den I go distroy dis temple, just as I distroy Shiloh. I go make sure sey evribody for dis eart dey curse dis town.’ ”


Una won go fight Babilon pipol, but una sojas nor betta pass doz wey don die, bikos as I dey vex, I don make up my mind to distroy dem. I don turn from dem, bikos of dia wikedness.


Di Oga wey bi Israel God sey, “Make yu go tell King Zedekaya for Judah sey, ‘Mi, wey bi God, go give dis town to Babilon king and e go burn am rish groun.


Bikos mi God don sey, I go orda dem and dem go kom di town again. Dem go attack, seize and burn am rish groun. I go turn Judah town to desert where nobody dey stay.’ ”


Den I tell Zedekaya, “Israel God sey, ‘Yu nor go die if yu surenda give Babilon king and dem nor go burn dis town rish groun; both yu and yor family go live.


But if yu nor surenda, Babilon pipol go take dis land; dem go burn di town rish groun and yu nor go fit eskape from dem.’ ”


Den I sey, “Dem go take all yor wifes and shidren go give Babilon pipol and yu too nor go fit eskape. Babilon king go katch yu as prisona and dem go burn dis town rish groun.”


Dem still hear wen I sey, “God sey, ‘I go give Babilon sojas dis town and dem go seize am.’ ”


sey make I tell Ebed Melek wey kom from Ethiopia sey, “Israel God wey dey mighty sey, ‘Just as I promise, I go distroy dis town and nor-tin go remain.’ And yu go si am wen e dey happen.


By dat time, Babilon sojas don burn di royal palis and all di house wey dey Jerusalem rish groun, den dem kon skata di wall.


“ ‘Bikos of dis, mi wey bi Israel God, go turn against una kon distroy Judah.


I go make sure sey, una nor prosper and dem go distroy una finish. Diziz and war go kill una, until nobody go remain again.


E burn God temple, di royal palis and all di house for Jerusalem. E distroy all di betta-betta house for di town


and ponish Jerusalem pipol. Dem don eskape one fire, but naw, betta fire go burn dem finish. Wen I don ponish dem, den una go know sey na mi bi God.


Naw, put di empty pot on-top di shako, den leave am make e red well-well. Den di pot go dey klean again afta fire don burn di yeye tins wey dey inside komot.


“ ‘If any Israel pesin or strenja wey dey stay for di land chop meat wey still get blood, God go turn against am and e nor go dey among God pipol again.


I go turn against una kon make una enemies win and di pipol wey hate una, go rule una. Fear go katch una sotey una go dey run wen nobody dey porshu una.


So I go distroy Judah kon burn all di strong-strong buildings wey dey Jerusalem rish groun.”


If dia enemies karry dem go as slave, I go orda make dem kill dem. I don ready to distroy dem and nor bi to help dem.”


But evritin wey I tok thru my profets, happen to una grand-grand papa dem, just as I tok am. So dem turn from sin kom meet mi kon sey, ‘Oga God wey dey lead heaven sojas, na en really ponish us, just as wi deserve am. E don do wetin E sey E go do.’ ”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ