Jeremaya 20:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
11 But God wey strong and get pawa, dey my side. So doz wey dey plan against mi, go fail. Yu go disgrace dem forever, bikos dem nor go susid and dem nor go ever forget di disgrace.
So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.
God sey, “Israel pipol, as una small and dey weak rish, make una nor fear, bikos I go help una. Mi wey bi Israel God wey dey holy, na mi bi di only Pesin wey go save una.
Mi, God don promise to make yu strong like town wey dem dey guide well, wey nobody fit skata and like pila wey dem use iron take make or wall wey get bronze. Yu go fit stand against di whole land: dat is, Judah king, en ofisas, priest and all di pipol for di land.
Den I ansa, “My God! Yu know as I dey sofa. Abeg make Yu remember kon help mi. Make Yu revensh doz wey dey tok bad against mi. Nor sorry for dem, so dat dem nor go kill mi. Make Yu remember sey na bikos of Yu, dem dey curse mi.
Yu don show betta love to many-many pipol and Yu don still ponish pipol, bikos of dia papa and mama sin. Yu bi great God wey get pawa well-well and Yu dey rule evritin.