Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jeremaya 20:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 I hear as pipol dey gossip mi. Dem dey koll mi, “Di Man Wey Fear One Kill.” Dem dey treaten sey, “If yu tok anytin here, wi go ripot yu.” Even my friends before, dey look and dey wait make I fall. Dem dey sey, “E go fall enter di trap, den wi go know sey wi don revensh am back.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jeremaya 20:10
35 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jezebel kon send message go meet Elijah dey warn am sey, “Make di juju dem judge mi, if I nor kill yu by dis time tumoro, just as yu kill di Baal profets.”


Wen King Ahab si Elijah, e kon sey, “My enemy, yu don find mi si abi?” Elijah ansa, “Yes! I don find yu si. Yu don do wetin nor dey good at-all for God eye.


Una go tell dem make dem put am for prison kon gi-am bread and wota till I go kom back.”


King Ahab ansa, “E get anoda one, en name na Mikaya wey Imlah born. But I hate am, bikos e nor dey profesai anytin wey dey good give mi, na only bad tin e dey tell mi.” King Jehoshafat kon sey, “Make yu nor tok like dat!”


My klose friends dey look mi with shame and di ones wey I love, don turn against mi.


I don hear evritin wey dem dey tok and e dey make mi fear. My enemies gada dey plan how dem go take kill mi.


But my Oga God, I trust Yu, bikos na Yu bi my God!


So Oga God, make Yu sorry for mi. Make I well again, so dat I go pay dem back!


Even my best friend, di one wey I trust with evritin; pesin wey wi dey chop togeda, don turn against mi.


Na lions gada round mi so! I dey with pipol wey won kill mi; pipol wey dia tit sharp like spear and arrow and wey dia words dey kut like swods.


Anybody wey pritend sey e like pesin, dey lie and anybody wey dey lie waka, na fool.


God go distroy doz wey dey lie against dia neighbours; pipol wey dey katch and kill pipol and doz wey nor dey give korrect judgement.


Dem go attack yu, but dem nor go fit win yu, bikos I go dey der to save yu. Mi, wey bi God, don tok.”


Before dis time, I bi like lamb wey dem won go kill, even doh I nor know anytin. I nor know sey na mi dem dey plan dis kind wiked tin for. Dem bin sey, “Make wi kut di tree naw wey e still dey fresh; make wi kill-am, so dat nobody go remember am again.”


Den God tell mi about some men from Anatot wey wont make dem kill mi. Dem don treaten mi sey, “Make yu stop to tok about God, if not, wi go kill yu!”


Den di pipol sey, “Make una kom, make wi do sometin about dis Jeremaya! Wi go always get priest wey go dey to tell us wetin wi go do; wise pipol go dey wey go advise us and wi go always get profet wey go prish God word give us. So make wi lie against am kon stop to listin to anytin wey e tok.”


But di next day, afta Pashhur don release mi, I kon tell am, “God nor koll yu Pashhur, but di name wey E give yu na, ‘Fear Dey Evriwhere.’


But wen I rish Benjamin Gate, Irijah wey Hananaya pikin Shelemaya born wey bi di guards oga kon stop mi dey sey, “Na Babilon sojas send yu kom spy dis land!”


So my pipol, make una nor go farm or travel go anywhere, bikos di enemies dey der with dia swod and dem dey kause wahala for evriwhere.”


Some of una dey lie for pipol head, so dat dem go kill dem. Some dey chop food wey dem don sakrifice give juju and some like ashawo life.


So di oda two men and di govnors kon dey find how dem go take trap Daniel, but dem nor si, bikos all wetin Daniel dey do, dey rite.


Den di Farisee pipol and di law tishas kon dey wosh Jesus well-well. Dem send some pipol go pritend like sey dem dey follow Jesus, so dat dem go fit use en word against am, kon ripot am to di Roman Govnor.


dem nor fit show yu di offence wey dem akuiz mi sey I kommit.


Wen di priest oga dem hear dis tin, dem kon vex well-well and won kill di apostles.


As di kansol membas hear all di tins wey Stefen tok, dem kon dey vex well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ