Dem rijet en rules; di kovenant wey E make with dia grand-grand papa and di laws wey E sey make dem obey. Dem dey respet juju wey nor mean anytin and like dis, dem nor mean anytin to God again. Dem dey bihave like di kountries wey dey around kon make God dey shame for dem.
God sey, “Dis pipol sey dem dey obey mi, dem dey tok good-good tins about mi, but dem nor really dey respet mi and evritin wey dem tok nor rish dia heart. Dia relijon na law and tradishon wey human being make with dia own hand.
“Pipol wey dey make juju nor mean anytin and di juju wey dem tink sey dey give dem happiness, nor mean anytin at-all. Di pipol wey dey serve di juju nor dey si and dem nor know anytin; so na shame and disgrace go follow dem.
Na Yu plant dem like tree kon make dia rut strong for groun and dem dey grow and bear betta fruit. Dem dey always tok about Yu even doh dem nor kare about Yu.
Just as no one among di juju for dis nashon fit bring rain, na so too di sky nor fit make rain fall by ensef. So wi don put awa hope for yor hand. Na Yu bi awa God, bikos na only Yu fit do all dis tins.”
Pipol for dis generashon! Make una listin to wetin God dey tok: “Israel pipol, I bi like desert for una eye naw? Abi, I bi like land wey dark well-well? So wetin make my pipol dey sey, ‘Wi don free from God hand and wi nor nid am again!’
I dey hear my pipol dey kry for evriwhere for di land sey, ‘God nor dey Zion? Abi Zion king nor dey der again?’ ” But God ansa, “Wetin make una go woship juju kon make mi vex?”
“Man pikin, di pipol where dey Jerusalem dey tok about yu and di odas wey dey for strenjas land. Dem dey sey, ‘Doz wey dey dem karry go Babilon nor go fit woship God, bikos of where dem dey. So God don give us di land.’
“Why una won do dis kind tin? Wi too na human being like una! Wi kon tell una di Good News, wey go make una turn from sin kom meet God, wey make heaven, eart, sea and all di tins wey dey inside dem.
Even doh dem know sey God dey, dem nor dey gri gi-am glory as God. Dem nor dey tank am for all di tins wey E dey do. Instead, na nonsense tins dem dey do and dia wiked mind nor fit undastand di trut again.
Dem don make mi dey vex for di gods wey dem dey serve; dem don make mi dey vex well-well with tins wey nor mean anytin: So, I go make dem jealous doz wey nor bi human being: I go make dem vex well-well for kountry wey nor get sense.