Wetin una go gain if una go back to Egypt go beg dem to kom help una? Wetin una tink sey una go gain, if una go Assyria go beg to drink wota from Eufrates River?
How una won take sey wi dey klean and wi neva woship Baal. Make una si as una sin for Hinnom Valley! Si evry tin wey una do! Una bi like woman kamel wey dey sleep with difren man kamel.
Jerusalem pipol, make una shaut and mourn as una dey go Lebanon. Make una kry go Bashan land; make una shaut well-well for Moab mountins, bikos dem don distroy una propaty.
Pipol wey nor bilive, na wen una go stop to waste una time? Mi wey bi God promise to bring new tin kom dis eart and e go dey special like wen woman dey protet man.”
“Make yu tell Zedekaya wey sey make yu pray make I help dem sey, ‘Egypt sojas wey bin dey kom help yu, go-go back to dia town wen dem don help yu finish.’
Na breeze Efraim pipol dey chop. Dem dey porshu breeze from morning go rish nite. Dem dey gada lie and wahala kon enter agriment with Assyria and dey do business with Egypt pipol.
Assyria pipol nor go fit save us and awa shariot nor go fit protet us. Wi nor go ever tell juju again sey, ‘Na yu bi awa god!’ Na Yu God dey save doz wey nor get papa and mama again.”
Wen Israel si as e dey sick and Judah si as e sore big rish, dem kon go meet Assyria great king make e kom help dem, but e nor fit cure or heal dia wound.
Efraim pipol dey waka up-and-down like bird wey dem dey kwik deceive; dem koll Egypt pipol make dem kom help dem fight; but afta, dem run go koll Assyria pipol too!