Jeremaya 2:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
26 So God sey, “Just as dem dey disgrace tif wen dem katch am, na so too I go disgrace Israel pipol, dia kings, ofisas, priests and profets, bikos of wetin dem do.
From awa grand-grand papa time kon rish naw, wi wey bi yor pipol don sin well-well. Na bikos of awa sin, wi, awa kings and priests, fall for strenj kings hand and dem kill, tif and karry us go as prisonas. Dem don disgrace us well-well as wi dey today.
But disgrace dey follow pipol wey dey woship juju; doz wey dey make mout about dia god wey nor bi anytin, bikos evry oda god must bow before di Oga awa God.
Si, shame go follow evribody wey dey woship dat god, bikos na human being make am. So make dem kom make wi judge di kase, den una go si sey, fear go katch dem and dem go disgrace demsef.
“Pipol wey dey make juju nor mean anytin and di juju wey dem tink sey dey give dem happiness, nor mean anytin at-all. Di pipol wey dey serve di juju nor dey si and dem nor know anytin; so na shame and disgrace go follow dem.
I go must do am, bikos of di bad-bad tins wey Judah and Jerusalem pipol don do. Bikos of di wiked tins wey dem do, I go distroy am with both dia king, leaders, priests and profets.
Di priests break my law and dem nor dey respet anytin wey dey holy. Dem nor know wetin dey holy or not. Dem forget di Sabat; dem nor dey tish about wetin dey klean again. So bikos of dis, Israel pipol nor dey gri respet mi again.