Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jeremaya 2:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Wetin una go gain if una go back to Egypt go beg dem to kom help una? Wetin una tink sey una go gain, if una go Assyria go beg to drink wota from Eufrates River?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jeremaya 2:18
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For dat time, King Ahaz kon ask Assyria king make e help am.


go sell food wey dem harvest for Egypt and dey do business with pipol for oda kountry.


Pipol wey dey go Egypt for help, curse dey dia head! Dem dey put dia hope for di plenty sojas, ordinary horse and shariot wey Egypt get. But dem nor trust Israel God or kom meet am make E help dem!


Wen dat time rish, God go bring di pesin wey dey barber hair for Eufrates side, wey bi Assyria king and e go kut di hair wey dey una face, head and body komot.


Wetin make una dey waka anyhow and dey shange una ways? Just as Assyria pipol disgrace una, na so too Egypt pipol go do una.


Pipol wey nor bilive, na wen una go stop to waste una time? Mi wey bi God promise to bring new tin kom dis eart and e go dey special like wen woman dey protet man.”


Naw, awa eyes dey pain us well-well, bikos wi dey wait for pipol to kom help us. But wi just dey wait for nor-tin, bikos dem nor go fit help us.


Wi don make agriment with Egypt and Assyria pipol, so dat wi go get enough food to chop make honga nor for kill us.


Bikos nor-tin dey rish yu, yu kon dey follow Assyria pipol. Even doh yu bi dia ashawo, dem nor still dey okay for yu.


But Judah king go against Babilon king. E go hire horse and many sojas from Egypt. Naw, with all dis one, e go fit win di fight against Babilon king? E go fit do wetin e plan? E go fit break di agriment and nobody go ponish am?


make all dis tins dey happen to yu. Yu bi dia ashawo and yu don spoil yor body with dia juju.


Wen Israel si as e dey sick and Judah si as e sore big rish, dem kon go meet Assyria great king make e kom help dem, but e nor fit cure or heal dia wound.


Efraim pipol dey waka up-and-down like bird wey dem dey kwik deceive; dem koll Egypt pipol make dem kom help dem fight; but afta, dem run go koll Assyria pipol too!


from Shihor River for Egypt east go rish di nort side wey face Ekron (dem dey koll am Kanaan aria), plus di aria wey bi di five Filistia pipol oga own for Gaza, Ashdod, Ashkelon, Gat and Ekron; plus Avvim pipol land


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ