Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jeremaya 18:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 and dat nashon stop to dey disobey mi, I nor go do wetin I bin sey I go do.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jeremaya 18:8
32 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Israel leaders and di king honbol demsef kon sey, “Na di korrect tin God dey do so o-o.”


E remember en kovenant with dem kon sorry for dem, bikos of en love wey nor dey fail.


bikos Yu dey save yor pipol and sorry for yor savants.


My God, make Yu kom back to us! Na how long wi go dey sofa like dis? Make Yu kom sorry for yor savants!


Why Yu won let Egypt pipol sey, ‘Dia God save dem with di mind to kill all of dem for di mountin kon distroy dem komot from di eart?’ Make Yu shange yor mind about wetin Yu won do yor pipol, so dat Yu nor go dey vex for dem.


God shange en mind, so E nor kon ponish en pipol again.


But dem must first asept my pipol relijon with dia heart and as dem make my pipol swear with dia Baal juju, na so too, dem go use my name take swear kon sey: ‘Wi swear with God wey nor dey die.’ If dem do all dis tins, I go add dem join my pipol.


Una don rijet and turn from mi and na dis make mi vex kon bring wahala for una. I don taya to dey sorry for una.”


Una must shange kon obey di Oga una God. Una must stop to live di bad life and wiked tins wey una dey do. If una stop am, God go shange en mind and E nor go distroy una.


“King Hezekaya and di pipol nor kill Mikaya, abi dem kill-am? But King Hezekaya honor God kon try to win en favor. So, God kon shange en mind and E nor distroy dem again. But as e bi so, wi dey won kause sirious wahala for awasef.”


May bi dem go listin kon stop to do di wiked tins wey dem dey do. If dem stop, I go shange my mind and I nor go distroy dem again.


May bi, if Judah pipol hear di way I won take distroy dem, dem go shange from all di bad-bad tins wey dem dey do, den I go forgive all dia sin and wikedness.”


‘If una ready to stay for dis land, I go build una up and una nor go skata again; I go plant una and nor-tin go fit rut una again. Na pains and sorrow full my heart, bikos of di wahala wey I kause for una.


“If wiked man stop to sin kon dey obey my law; dey do wetin dey rite and good, e nor go die, but e go get life.


Tell dem sey, ‘God sey, “As long as mi wey get pawa dey alive, I nor dey happy to si doz wey dey sin, dey die. I prefer make dem stop to sin, so dat dem go get life wey nor dey end. So, Israel pipol, make una stop di wiked tins wey una dey do. Na wetin make una won kill unasef finish?” ’


“Naw, man pikin, go tell Israel pipol sey wen good pesin sin, di good wey e do, nor go save am. Like dis too, if wiked man stop to do bad, I nor go ponish am, but if good man start to sin, I nor go sorry for am at-all.


I fit promise good man good life, but if e bigin tink sey di good wey e do before go save am, den e start to sin, I nor go remember all di good wey e do. E go die, bikos of en sins.


Like dis too, I fit warn wiked pesin sey e go die, but if e stop di bad tins wey e dey do kon dey do wetin good and rite;


Efraim pipol, how I won take leave or abandon una? I nor fit distroy una just as I distroy Admah pipol or trit una as I trit Zeboiim pipol? My heart nor go let mi do am, bikos di love wey I get for una, too strong.


Make una hate bad tins kon love to do good, den dey judge well for kourt. May bi God go sorry for di pipol wey still remain for dis land.


Den e kon dey komplain to God, “My God, before I komot from my kountry, I know sey dis na wetin Yu go do? Na dis tin make mi try to run go Tarshish! I know sey Yu dey sorry and kare for pipol and Yu get patient, dey kind and instead of Yu to ponish pipol, Yu always dey ready to forgive dem.


God go judge en pipol and E go shange en plan about en savant; wen E si sey dia pawa don vanish and nobody remain again, weda na slave or free pesin.


As long as di leaders wey God give di pipol dey alive, E help and diliver dem from dia enemies. God sorry for dem well-well wen dem kry to am with pain, bikos of wetin dia enemies dey do dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ